Jisos Go Kom Bak For Earth Agen

Randal ensef kom put one gist from Paul book of 1Thessalonians. "As we de wait, make we de serve God with all we heart and de preash to other pipo tuu." En kom add say born again pipo wey don die go dey with Jisos Christ for di time wen en go kom bak for di earth agen. My pipo, make una hear Randal as en de give us di torri of “Jisos go kom back …read more

Jisos Go Back Heaven

Mek una hia am for Peter mouth. Peter, nadat fear-fear follow bodi pesin wey swear say en no sabi Jisos for di time wen dem catch am, kom later run go bak for en fish business; but afta, e kom dey strong, kon get open-eye, as beta messenger wey give evritin wey en get for Jisos. Na en bi do pesin wey go put dis ogbonge Torri wey bi “Jisos Go back to heaven.”

Jisos Raiz From Deat

Dis tin wey dem bin no undastand, now com de mek plenty sense. Jisus, wey bi de Mesiah, de Wan God bin promise, bin kom laik Savant wey dey suffa, no bi laik king wey bi warrior. Di persin wey no get sin na Em pay for awa sin by di die wey Em die ontop di kross. As Em raiz from deat, En ovacom di power wey sin and deat get. Listen now mek John tel us di torri of “Jisos raiz from deat”

E Dai

Even though Him death first come luk like say him don lose, we go see say Jesus jejely give Him laif. Just like de lamb wey dem take do sacrifice, Him carry awa sins on top Him shoulders. Him pay the gbese wey we suppose pay for the plenty bad bad tings in awa laifs. Na dis kain plenty love Him get for evry one of us. John, one of de pipu wey dey follow Jesus closely go tell us de tori about how “Jesus Kpeme on top de Cross.”

Hope Don Dey Agen

Where wi won run go? Who we won mit wen wahala kom? Afta Jisos die, as won day pas, en pipo and en frends nor jus no wetin to do agen. Dem nor no who go ansa all diir kwesions. Mak Una hear awa last stori, “Hope Don Dey Agen”.

Wen Hope Don Finish

De kweshion kom bi, Wetin we go do wen e bi like say awa own don finish? Na wia we fit go for help wen help no dey any wia? Na dis kin wahala Jisos follow bodi pipo bin pass thru, and di kin kweshion dem ass for de day wen dem condemn Jisos. Follow us listen as we bring yu awa next torri wey bi “Wen Hope no dey.”

For Middle Of Two Thif Dem

If wi tok trut, wi go tok say dis life, nobody no ha tumoro go bi. Jos naw jos naw, evritin wen wi no for dis life don scatter bicos of one siknes abi disease. naw nor bi to onle mak moni bi di problem, bot wi mos survive tu. Ha wi go take survive if wahala kom? Wer wi go ron go wen evritin don scatter? If yu don go tru problem bifor wen shange yur life dis story from part 1 to part 6 go help yu get hope. Di story won stat naw, so opun yur ear, “For Middle Of Two Thif Dem”

De Sheep Dem Scatter

As e dey now for de world, wahala plenti, jus for small time, de new sikness don turn everythin upside down. Bikos of am, pipo mind dey for only how dem go take survive. … This drama wey yu go hear now go give yu hope. Make yu hear de torri wey dey follow, “De sheep dem scatter.”

De Passover

Wetin we go do wen e be like say everithin wey dey around us don scatter? Where we go run go wen nothing dey work for us again? If dis kind wahala don happen for yur life before, or yu dey pass thru am now, dis drama wey dey 6 in number, go give yu hope again. Make yu follow us listen now, for our next storri, “The Passover”

Warning Signs

Oya, wetin carry you come all dis side, na to tell me to pursue dis pipo or wetin?

Wetin Mek Evil Be Lai